Arsenal carry draw wit Sporting Lisbon comot Portugal for an entertaining Europa League last-16 first leg.
Dis go be di first time ova di five times wey dem don meet wey Sporting Lisbon go score goal against di Gunners.
Di march happun for di Estadio Jose Alvalade.
French defender William Saliba first put di Premier League leaders ahead with ogbonge header from corner wey midfielder Fabio Vieira sama am.
But Arsenal only hold dia lead for12 minutes before Goncalo Inacio nod in equaliser afta keeper Matt Turner no fit settle down afta corner kick by Marcus Edwars.
Paulinho supply di Sporting second goal before Japan midfielder Hidemasa Morita equalise Arsenal with own goal.

Post a Comment